Are These facts or Lies About Nigeria? [In Pidgin English]

Na only for Nigeria you fit win
Aeroplane by loading N200 MTN
Recharge Card.

Very soon Etisalat go say recharge
N200 and win a big ship.

Then Airtel go com follow sey,
recharge N100 and win Benin
Republic.

Glo, go just kuku say... Recharge
N500 and win Nigeria bcos their
colour na Green.

Na only for Nigeria you go see fish
inside"MEATPIE"

Na only for Nigeria we dey count
money after we withdraw am
from ATM because we no even
trust ATM machines.

Na only for Nigeria PHCN dey sey:-
Win a brand new GENERATOR if
you pay your light bill (wat a pity)

Na only for Naija people dey horn
for traffic light make e quick
change from Red to Green.

Na only for Nigeria Pharmacy dey
sell Coke, Recharge Card, Chin chin,
Puff puff and beer.

Wetin you no see for Naija, you no
fit see am anywhere in d world...
Trust me.

Na only 4 naija you go find a
graduate of Mechanical
Engineering wey dey do him NYSC 4
Police station.

Na only 4 naija you go see one
person dey use Bold5, X3, Ipad2
and Nokia N8 all at once.You be
Bill Gates? Abi na you invent
internet?

Na only 4 naija you go see a
graduate of law dey work as
generator repairer.

Na 4 only Naija, you go see Mad man dey control traffic,people wey their head correct dey obey...

Na 4 only Naija, wey you go see the president senior the country
herself.

Na 4 only Naija, you go see advert from native doctor on how to
make quick money.

Na 4 Naija obituary poster dem go say "MAMA HAS RELOCATED".


Don't forget to follow me on Twitter @simplysamad for more exciting gist, photos, interviews, reviews, jokes, quotes and other entertaining content | BB pin: 2B3D28E3.
By: SAMOD BIOBAKU

Comments